close

Authority Stealing Lyrics & Chords By Fela Kuti

LyricsView Chords

[Chorus]
Authority stealing!
You be thief (I no be thief)
You be rogue (I no be rogue)
You dey steal (I no dey steal)
You be robber (I no be robber)
You be armed robber (No be armed robber)
I no be thief (You be thief)
I no be rogue (You be rogue)
I no dey steal (You dey steal)
I no be robber (You be robber)
I no be armed robber (You be armed robber)
[Chorus]
Argument, argument!
Argument, argument, argue
Them argue
Everbody dem argue
Them dem dem argue
Up and down them argue
Everbody dem argue
Them dem dem dem argue
Yes yes, them argue
Everbody dem argue
Argument about stealing
Somebody don take something
Wey belong to another person
Then you go hear:
You be thief (I no be thief)...
On top of the road, on the side
People dey waka
Office workers, labourer workers, workers' workers
Them go dey waka
Inside bus them go dey
Motorcycle them dey ride
Plenty, plenty crowd
Inside this crowd
Sometimes for one corner
Sometimes for one street
You go dey hear: ha ha!
[Chorus]
Thief, thief, thief!
Rogue, rogue, rogue!
Robber, robber!
Catch am, catch am! Thief, thief, thief!
Catch am, catch am! Rogue, rogue, rogue!
Catch am, catch am! Robber, robber!
Catch am
Pull am
Get am
Keep am
Ole...
[Chorus]
Catch am, catch am!
Looking go start
Watching go start
Chasing go start
Somebody go dey
Wey them go grab
Them go beat am well-well
Them go lynch am well-well
Police go come well-well
Them go carry am go court
Them go put am for jail
Them fit put am six months
(Them go put am for one year)
Them fit put am two years
(Them go put am for five years)
Them fit put am seven years
(Them go put am for ten years)
If not them go shoot am well
Them go shoot am for armed robbery
On top of the road, on the side
People dey waka
Office workers, labourer workers, workers' workers
Them go dey try
To try to make ends meet
Them go dey hustle
To try to make ends meet
Them go put hands for back
To try to make ends meet
Them go dey beg oga
To try to make ends meet
Them go be slaves for them town
To try to make ends meet
I say turn your face small
To the right wing
Oga patapata dey for there
Authority people dey for there
Instead of workers
We have officials
Instead of buses
Them dey ride motor-car
Instead of motorcycle
Na helicopter
Instead of them waka
Na worker go waka for them
Authority people them go dey steal
Public contribute plenty money
Na authority people dey steal
Authority man no dey pickpocket
Na petty cash him go dey pick
Armed robber him need gun
Authority man him need pen
Authority man in charge of money
Him no need gun, him need pen
Pen got power gun no get
If gun steal eighty thousand naira
Pen go steal two billion naira
[Chorus]
Thief, thief thief!
Rogue, rogue, rogue!
Robber, robber!
You no go hear them shout
You no go hear them shout at all
You no go hear them say
You no go hear them say response at all
Na different way be them way
Na civilize style be them style
[Chorus]
Yes, yes, yes, yes!
"Oh yes, of course, contract, have some money back in hand, ha ha"
Hear the words them dey take deceive the people:
Misappropriation
Maladministration
Nepotism
Mitigation
Make I remember another one wey them dey use
Defraudment
Forgerylization
Embezzlement
Vilification
Mismanagement
Public inquiry
Authority stealing pass armed robbery
We Africans we must do something about this nonsense
We say we must do something about this nonsense
I repeat, we Africans we must do something about this nonsense
Because now authority stealing pass armed robbery
Authority man him go dey steal
Public contribute plenty money...
[Chorus]
Authority stealing!

Tracks related to authority stealing - fela kuti

djuru

by: amadou & mariam

my one and only love

by: michael brecker

so what

by: john coltrane

malumbulo

by: ed motta

taxi nocturno

by: axel krygier

hot dog

by: the greyboy allstars

mercy mercy me

by: the apostles

tante marie

by: orchestra baobab

wane ma maguiss

by: orchestra baobab

saci pererê

by: banda black rio

haitian lady

by: willie bobo

oleo

by: george benson

stargazer

by: down to the bone

amnesia

by: chick corea elektric band

my jamaican girl

by: brooklyn funk essentials

loving you

by: sunset blvd.

freak out

by: candy dulfer

chacha were

by: new cool collective

nishiombo

by: new cool collective

deep shyt we

by: the crusaders

taoumba

by: manu dibango

reality

by: adriana evans

igbe

by: fela kuti

power show

by: fela kuti

funky motion

by: ronnie foster

habanerando

by: richard galliano

jessica

by: herbie hancock

mojuba

by: herbie hancock

close
Sign in person Home A to Z All Artists Top Artists Top Tracks